OBI XTRA Good Youths cover image

Good Youths Lyrics

Good Youths Lyrics by OBI XTRA


I Dey pray for the good youths ooooh oh oh
Our country no good ooooh oh oh

Pause
I woke up dis morning
Look into my phone
And I see people crying yea
They say people are dying
Yama yama dey
And the leaders are lying
Dem know say the country no good
So they carry all the money dey run to Dubai
Everything they see Dem go buy
Na only their families Dey chop better life
Good road we no get
Health care we no get
Steady power supply we no get
And dem still dey calculate the budget
Motor we no get
Okada sef na the closest
People Dey waka for protest
All of our leaders
Dey fly for private jet
Shey police suppose protect you
So why police dem come dey harass you
Shey na like dis we go dey
Since 1960 we still never change o

Time don reach for revenge (hey)
Time don reach for revenge o (hey)
Time don reach for revenge
Baba fela talk say na we be the change o

So I Dey pray for the good youths ooooh oh oh
Our country no good ooooh oh oh
People Dey hungry
No food ooooh oh oh
And our leaders Dey use us play
Dem think say na yesterday yea

Tell dem say we don wise up now
Hands in the air
Make we rise up now
If they stop you for road
Dem go kill you now
R.i.p to the ones
Wey dem don take down yea
Make we rise up now
Hands in the air
Make we rise up now
If they stop you for road
You fit die right now
So shout out to the ones
Wey Dey fight right now
If you know
You go know say na promise and fail
Wey dem just Dey do us
But when it’s time to vote
Na that time
Wey dem Dem go like to dey use us

But time don reach for revenge  (hey)
Time don reach for revenge o (hey)
Time don reach for revenge
Baba fela talk say na we be the change o

So I Dey pray for the good youths ooooh oh oh
Our country no good ooooh oh oh (our country no good oh oh)
People Dey hungry
No food ooooh oh oh (oh no no)
And our leaders Dey use us play
Dem think say na yesterday yea
I Dey pray for the good youths ooooh oh oh
(I Dey pray, I Dey pray, i Dey pray oh)
Our country no good ooooh oh oh (e no good oh oh)
People Dey hungry
No food ooooh oh oh (People Dey hungry need food oh)
And our leaders Dey use us play
Dem think say na yesterday yea

Watch Video

About Good Youths

Album : Good Youths (Single)
Release Year : 2023
Added By : Phrazy
Published : Jun 24 , 2023

More OBI XTRA Lyrics

OBI XTRA
OBI XTRA
OBI XTRA

Comments ( 0 )

No Comment yet



About AfrikaLyrics

Afrika Lyrics is the most diverse collection of African song lyrics and translations. Afrika Lyrics provides music lyrics from over 30 African countries and lyrics translations from over 10 African Languages into English and French

Follow Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl