...

Amaka 2.0 Lyrics by COBHAMS ASUQUO


Amaka talk say she dey go see doctor

To see wetin she go fit do

Because she need small waist

With big bum bum

Something that can make a man move

She hearsay Folake don dey drive Benz

Dem talk say Onome don dey fly jet

Forget say Onome no get talent

Now she be number one boo

For minister wey get three wives

And two side chics

Amaka dey reason dey reason

Shey her whole life go remain like this

Amaka remember your Mama

Remember your Papa

You get family wey still love each other

Remember your sister

Remember your brother too

Amaka you fit no be ajebutter

You no come from moola

Remember say you no come from gutter

The God wey you dey serve

Is still very powerful

Amaka dey reason dey reason

(Amaka slow whine

Float like a boat on a ocean whine

Amaka dey disturb with this waistline

Everything go set it will only take time)

Amaka do the dotty whine

She dey whine like say

Spring dey her waistline

You go school you graduate

With a 2.1 or 2.2

No be you dull pass abi dem dey do you

Her classmates some dey look for employment

But dem gats fake so dem use style dey try blend

On top group reunion dem come flex

Na im dey make Amaka search

For politician wey get three wives

And two side chics

She dey reason dey reason

This her whole life

She wan catch big fish

Amaka remember your Mama

Remember your Papa

You get family wey still love each other

Remember your sister

Remember your brother too

Amaka you fit no be ajebutter

You no come from moola

Remember say you no come from gutter

The God wey you dey serve

Is still very powerful

Amaka dey reason dey reason

(Amaka slow whine

Float like a boat on a ocean whine

Amaka dey disturb with this waistline

Everything go set it will only take time)

Watch Video

About Amaka 2.0

Album : (Single)
Release Year : 2024
Copyright :
Added By : Farida
Published : Aug 29 , 2024

More COBHAMS ASUQUO Lyrics

COBHAMS ASUQUO
COBHAMS ASUQUO
COBHAMS ASUQUO
COBHAMS ASUQUO

Comments ( 0 )

No Comment yet



About AfrikaLyrics

Afrika Lyrics is the most diverse collection of African song lyrics and translations. Afrika Lyrics provides music lyrics from over 30 African countries and lyrics translations from over 10 African Languages into English and French

Follow Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl