BLACKFACE NAIJA Mathematics  cover image

Mathematics Lyrics

Mathematics Lyrics by BLACKFACE NAIJA


Omo the matter pass me oh
I solve solve solve omo I no even get any answer at all
Abeg which which eh…
Formula you feel say I for take
Take to solve this our naija matter because eh…
E tire me

Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so
Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so

These people them bad
These people them kala
Put we ina sufferation, new day new wahala
Those wey dey enjoy na those way dey power
While my people gat no light, no food them dey suffer
We no know where we dey go
E be like say na blind men dey lead the road
Media dey do them own and white go turn black
Them want make we no know
Na which kind thing be thief I thief
You dey feel my plea
If them give them chance
Them go make life hard Instead of make life sweet
To solve the puzzle for the bottle
We gats shine our eyes to see say politicians
Them wan use us die and ah
We are the lions for the jungle
Time to fight for your rights
My people make we do the maths

Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so
Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so

Why we no get light?
We no know
Why no good roads?
We no know
The budget for the projects in the projects in the ghetto
When e go complete
We want know
Why insecurity high?
We no know
Fulani na herdsmen?
We no know
I hear some politicians are them sponsors
Some of them are amongst us
Tell me why them dey
We want know
The government this, the government that
Na their people them dey give e contract
Political appointment na their house e start
What of my brothers and my sisters (my sisters)
One Nigeria ne
Ogbeni wetin you tell me again?
I pledge to serve my country with all my strength
No go ask me wetin I gain
So wetin bring division between idomas and Igbos?
Yoruba hausa dey do igbati gboos
Ipoh and bandits them loyal to the boss
And politicians them dey do like them no know
Them no know heh?
Why cost of living dey high?
Why e be say na only the rich be getting by?
Politicians budget for them furniture
Dey cost pass our children education
Make somebody tell me why?

Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so
Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so
Why we no get light?
We no know
Why no good roads?
We no know
The budget for the projects in the projects in the ghetto
When e go complete
We want know
Why insecurity high?
We no know
Fulani na herdsmen?
We no know
I hear some politicians are them sponsors
Some of them are amongst us
Tell me why them dey
We want know
If you ask me… na who I go ask?
These politicians dem don marra
They don’t know how to act
If you ask me… na who I go ask?
These politicians dem don marra
They don’t know how to act
Give them money to repair our roads, wankoje
Give them budget to upgrade hospital, wankoje
Give them infrastructural money, wankoje
Awonwere’ wankoje
Money wey go give my people light, wankoje
Money wey go give my people water, wankoje
Money wey go give my people house, wankoje
Awoni’eranu’ talokoje?
Charley!!!
These questions wey we dey ask my people
I believe say we dey up to the task
And this no be time to relax till them politicians come up
With the facts, oya make we …

Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so
Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so
Hardlife na the first one… haha
Tell them say me back with another one
What?  Politicians … ha
If you can’t make naija better don’t make it worse for us
Pack out fast
Let’s us be prosperous, ha
Eden kill them with beat
No surrender, no retreat, awol

Watch Video

About Mathematics

Album : Mathematics (Single)
Release Year : 2021
Added By : Farida
Published : May 25 , 2021

More BLACKFACE NAIJA Lyrics

BLACKFACE NAIJA

Comments ( 0 )

No Comment yet



About AfrikaLyrics

Afrika Lyrics is the most diverse collection of African song lyrics and translations. Afrika Lyrics provides music lyrics from over 30 African countries and lyrics translations from over 10 African Languages into English and French

Follow Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl