ERIGGA Area To The World cover image

Area To The World Lyrics

Area To The World Lyrics by ERIGGA


E pain me say na wen I go na hin everywhere burst
People wan know if na true dey check insta blog
Prapas dey throw backie happy wan kill dem die
I say make bar no dey again people go feed dem die
Even rappers wey no dey post my song before
Fake love don put me for their profile pic
They screenshot their dm wen I dey write dem
Say make we make feature see me see problem
Followers don increase go 1.5 m
OAP since morning dey drive me for Fm
My videos wey soundcity no gree accept  
Dey on every rotation even my concert
I pray for ? but oluwa forbid
My song go speak for me anyhow e be
Who go better go better na time e go take
Day break everywhere burst for goodness sake

I say tell dem the full story but dem no dey believe o eh
No matter how you watch film d story inside no  fit change o
I be dey give dem the  full load down but but dem no believe o eh
Who God don bless world people no fit change o

Area o, area o, area o ehh ( Warri to d world)
To the world o , to the world o , to the world o eh
Area o area o area oo eeeh
To the world o to d world to d world o eeh


I remember wen I no get bar
That year na wen I dey je eba
Madam know me just put soup with 5 eba
No be enjoyment I come na for survival
No where to go wetin man go do
Na around 2 we dey thief fuel from people motor
Dey sell give who get I pass my neighbor
Rechargeable lamp dey listen to to my all man Deebo
As e dey give us gist abt all celebrities
No internet Na him be out everything
I remember when I track am for DBS
Give am my jam e no play am e pain my chest
Because I know d stress wen I don go through
No sponsors sef na money why u save for school
Na hin I take record am wetin man go do
Give up no join am na ballings

I say tell dem the full story but dem no go believe o
No matter how u watch film d story inside no go fit change o
I be dey tell dem the full load down but dem no believe o
Who God don bless world people no fit change o

Area o, area o, area o ehh
To the world o, to the world ehh, to the world
Area o area o area o ehn
To the world o to the world oo to d world

Omo see the character
Na only time e go take stammerer go call him papa name

Motivate your mother*cking self man

 

Watch Video

About Area To The World

Album : The Erigma II (Album)
Release Year : 2019
Added By : Regee
Published : Oct 07 , 2019

More ERIGGA Lyrics

ERIGGA
ERIGGA
ERIGGA
ERIGGA

Comments ( 0 )

No Comment yet



About AfrikaLyrics

Afrika Lyrics is the most diverse collection of African song lyrics and translations. Afrika Lyrics provides music lyrics from over 30 African countries and lyrics translations from over 10 African Languages into English and French

Follow Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl