LADE Adulthood Anthem cover image

Adulthood Anthem Lyrics

Adulthood Anthem Lyrics by LADE


Nobody go ask if you don chop
Nobody go send you free money
If you no get now you sabi
Adulthood na scam
Aah ha, la la la la
I heard that you looking for Ladè oh
(Please don't judge me)
Coz I won't judge you oh
Na wetin dey tell me I believe
Na wetin dey tell you, you believe

As I wake up this morning
Landlord don call me
My padi don ring my phone
Say where that thing you promise me
I know say you no go believe
Them no tell me say na so e dey be
Abeg you take back to days
When e be na just to play and chop

Aaah! Adulthood na scam
You better get am for your mind
You gast to hustle, make a living 24/7
Nobody go ask if you don chop
Nobody go send you free money
If you no get now you sabi
Adulthood na scam

If you no get now you sabi
You no fi reason your padi o
But if na them need you
Dem go come to you
Come dey give you different (Story o, story o)
This is super story o
Though the story touch me o
But I no fit send you money o
If I say make I calculate (Calculate)
Wetin I dey spend from Monday to Sunday (Sunday)
Dey make me reminisce on those days
Wey pocket money go yapa for my pillow case o
Now I gast send money lo le oh
Everything wey I want I must pay o, mogbe o
I fit to give anything to become a child again

Aaaah! Adulthood na scam
You better get am for your mind
You gast to hustle, make a living 24/7 (dem no dey tell pesin)
Nobody go ask if you don chop (dem no dey yarn pesin)
Nobody go send you free money
If you no get now you sabi
Adulthood na scam
Adulthood na scam
You better get am for your mind
You gast to hustle, make a living 24/7
Nobody go ask if you don chop
Nobody go send you free money
If you no get now you sabi
Adulthood na scam

Leave me I want become a child again yeah yeah
I want become a child again yeah
I want to play inside the rain, uh-huh
Coz adulthood na scam

Watch Video

About Adulthood Anthem

Album : Adulthood Anthem (Single)
Release Year : 2022
Added By : Farida
Published : Jun 16 , 2022

More LADE Lyrics

LADE
LADE
LADE
LADE

Comments ( 0 )

No Comment yet



About AfrikaLyrics

Afrika Lyrics is the most diverse collection of African song lyrics and translations. Afrika Lyrics provides music lyrics from over 30 African countries and lyrics translations from over 10 African Languages into English and French

Follow Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl