PRINX EMMANUEL God No Go Shame Us cover image

Paroles de God No Go Shame Us

Paroles de God No Go Shame Us Par PRINX EMMANUEL


I call my brother for phone
Dey ask am how e dey be
Him tell me say mehn
Everywhere don red!! And e get as e be!
I tell am say no worry
As long as say we no dey mortuary
See!!
We de alive, we still de breathe
E get something weh I believe

[CHORUS]
God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us
The blessing go loud, e go worry the neighbors
God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us
The blessing go loud, e go worry the neighbors

Oga this one no be bobo
I know de talk wetin I no know
When the time go reach for you to collect your bread
You go collect jumbo
E don tey weh you don de grind
And e be like say your own never enter (enter)
But when dem go send the alert
Alaye dem no go use xender (eh)
As for me I no get issues
Eledumare de the middle, ah!
Na him de shower the blessing
So when I de sow I no wan needle! (Wan needle)
Somebody wan carry my picture go babalawo
I tell am to wait fes
Say that picture weh him wan use no fine
Make I send am the one weh go make sense
Because ehn!

[CHORUS]
God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us
The blessing go loud, e go worry the neighbors
God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us
The blessing go loud, e go worry the neighbors

A say God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us

Ecouter

A Propos de "God No Go Shame Us"

Album : God No Go Shame Us (Single)
Année de Sortie : 2020
Ajouté par : Farida
Published : Jul 15 , 2020

Plus de Lyrics de PRINX EMMANUEL

PRINX EMMANUEL
PRINX EMMANUEL
PRINX EMMANUEL
PRINX EMMANUEL

Commentaires ( 0 )

Aucun commentaire pour l'instant



A propos de AfrikaLyrics

Afrika Lyrics est la plus large collection de paroles de chansons et de traductions d’Afrique. Afrika Lyrics fournit les paroles des musiques de plus de 30 pays africains et des traductions de lyrics de plus de 10 langues africaines en français et en anglais.

Suivre Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl