FALZ Talk cover image

Paroles de Talk

Paroles de Talk Par FALZ


Anything I talk make you talk am again
(Eh eh talk am again)
Anything I talk make you talk am again
(Eh eh talk am again)

[VERSE 1]
Brother Muri shout finish we no see am for court
(Eh eh we no see am for court)
Election don dey come dem go need your support
(Eh eh dem go need your support)
Since EFCC burst in, we no see you for club
(Eh eh we no see you for club)
And you get legit work o na wetin you talk
(Eh eh na wetin you talk)

[CHORUS]
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o

[VERSE 2]
Four year tenure
Three year holiday
(Eh eh, three year holiday)

Our senators don dey fight Kung-fu again
(Eh eh fight Kung-fu again)
Shey dem never tire? dem wan continue the race?
(Eh eh dem wan continue the race)
We buy your story but you no give us change
(Eh eh you no give us change)

[CHORUS]
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o

Anything I talk make you talk am again
(Eh eh talk am again)
Anything I talk make you talk am again
(Eh eh talk am again)

[VERSE  3]
Month don end Oga pay salary
(Eh eh Oga pay salary)
In 2019
19,800 allawee
(Eh eh 19,800 allawee)
Instead make you work, you dey find Alhaji
(Eh eh, you dey find Alhaji)
You come turn your body to cash and carry
(Eh eh cash and carry)

[CHORUS]
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o
Na you talk am o
No be me talk am o

[VERSE 4]
Three private jets
You say you buy am for church
(Eh eh, You say you buy am for church)
But your congregation no dey follow fly am of course
(Eh eh, dem no dey follow fly am of course)
Why your people still dey carry carry eye for someone
(Eh eh carry carry eye for someone)
Shey I no be person
Cause no be your tribe I come from?
(Eh eh Cause no be your tribe I come from)
Small man thief for market you set fire for em body
Big man thief money we dey hail am like dummy
We dey suffer, we dey smile
We dey fear to talk
My people no get chop, my people no get work
These days we no know if authority dey for office
Cause the yawa wey we see, no be security we you promise
And the cup don full, we don tire for all the rubbish
All the punishment
Na me talk am o!

Ecouter

A Propos de "Talk"

Album : Talk (Single)
Année de Sortie : 2019
Copyright : © BahdGuys Entertainment Limited, under license to Jungle Entertainment Ventures
Ajouté par : Farida
Published : Mar 09 , 2020

Plus de Lyrics de FALZ

FALZ
FALZ
FALZ
FALZ

Commentaires ( 0 )

Aucun commentaire pour l'instant



A propos de AfrikaLyrics

Afrika Lyrics est la plus large collection de paroles de chansons et de traductions d’Afrique. Afrika Lyrics fournit les paroles des musiques de plus de 30 pays africains et des traductions de lyrics de plus de 10 langues africaines en français et en anglais.

Suivre Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl