AKPORORO God No Go Shame Us cover image

God No Go Shame Us Lyrics

God No Go Shame Us Lyrics by AKPORORO


He no go shame us
He no go shame us
Baba God no fit shame us

Cut your coat according to your size brother
No let wetin people dey talk take pressure you
Some go say na your mates don get this don get that
Say many of them don get many properties brother eheh
Wetin work for Mr A fit no work for Mr B and C
When your Cloud full Your rain go fall
So make you put your head straight no give up
Always remember say
God no go shame us
Brother sister He no fit shame us
Ehh eheh God no go shame us oo
Anywhere you dey he no fit shame you

Anywhere Wey you dey, you dey ear my voice right now
Make you remember say Baba no go shame you
Inside prison education market place work place
Sick bed always remember say he no go shame you
Ehhh Things no dey go well for you
It be like say you dey work you no dey see money
Remember say he no go shame us
(Lift your voice and say)
God no go shame us
Anything wey you dey do he no go shame you oo
God no go shame us
Hit your chest and speak the word decree declare
God no go shame us
Open your mouth and
say he no go shame you, he no fit shame you
He no fit shame us
Give am chance make he come work for you
God no go shame us

Baba God no go carry last
cause he be first and the last
God no go shame us
He no go shame you He no fit fail you
He no go fall your hand, yehhh ehhhh
Always believe if you believe you receive
God no go shame us
He go do everything wey you want
God no go shame us
If you give am chance make hin work
God no go shame us
God no go fail you
God no go
he go come to your rescue
God no go shame us
Oya carry your own Ghana must go
God no go shame us
You no go surfer you no die like that
God no go shame us
baba God dey your side
If your cloud full your rain go fall
God no go shame us
baba God dey your side
baba God dey your side

Watch Video

About God No Go Shame Us

Album : God No Go Shame Us (Single)
Release Year : 2020
Added By : Farida
Published : Jul 27 , 2020

More AKPORORO Lyrics

Comments ( 0 )

No Comment yet



About AfrikaLyrics

Afrika Lyrics is the most diverse collection of African song lyrics and translations. Afrika Lyrics provides music lyrics from over 30 African countries and lyrics translations from over 10 African Languages into English and French

Follow Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl