2BABA Rise Up cover image

Rise Up Lyrics

Rise Up Lyrics by 2BABA


As gbege dey happen around the world 
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dappen 
Omo guy na your eyes you  go sharpen 
You need to take care of yourself
Cos the curve go flatten 
Better go dey  start to dey happen
Know say gbege  go come and go 
We suppose to jump am o
We suppose to know say we must to rise up again o
Gbege must come and go 
We suppose to jump am o
We suppose to know say We will rise up again o

Yawa dey today 
But hey morrow go better 
Gbege wey dey now e no go kill us never 
I collect 1 throphy make I take forget am 
2 bottles with 2baba we dey for gether 
Make I keep am short mi o fe soro ju
Everybody know say all my people dey colorful 
When the gbege jam us for body we lost 1 or  2
And the matter hook us for neck we no no what to do
Stop there turn round  you go see action
Where man fall down he go still rise up
Wetin no kill man na wetin make he sharp
And you no fir die for film na you be actor
You go wide the chest like you be man o war
You go wipe the death like you be janitor
You recharge energy and start afresh
Wether you dey Budapest, Lagos city marakesh 

As gbege dey happen around the world 
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dappen 
Omo guy na your eyes you go sharpen 
You need to take care of yourself
Cos the curve go flatten 
Better go start to dey happen
Know say gbege  go come and go
We suppose to jump am o
We suppose to know say we must to rise up again o
Gbege must come and go 
We suppose to jump am o
We suppose to know say we will rise up again

The pepper go still rest e go still rest ??
Better go still dey wey the flexing go dey unanimous
All my people turn up, turn up to the maxi
Bad water wey dey flow come no go fit carry us 
As I dey talk sho n gbo , sho n gbami gbo
All the quanter wey you think say ko le pari mo
So fun Tolani, Chidera pelu Amina 
Pe adura wa to gba e ma shey Amin mo
To the heros we lost we no go forget
Heaven prepare the medal wey dem go collect
 Our black panther don unite with black mamba
When the time come we  go still jam for wakanda
When you get up help us hala captain chika
And God bless the souls of Uwa and Tina 
We stand tough but no matter how e rough bad water wey dey flow gan e no fit carry us 

As gbege dey happen around the world 
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dappen 
Omo guy na your eyes you go sharpen 
You need to take care of yourself
Cos the curve go flatten 
Better go start to dey happen
Know say gbege  go come and go 
We suppose to jump am o
We suppose to know say we must to rise up again 
Gbege must come and go 
We suppose to jump am o
We suppose to know say we will rise up again o

It's  just one test for every man
The same thing happen inna every land 
E no be competition 
This one no concern politician 
It's  just one test for every man
The same thing happen inna every land 
E no be competition 
This one no concern politician 

As gbege dey happen around the world 
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dappen 
Omo guy na your eyes you go sharpen 
You need to take care of yourself
Cos the curve go flatten 
Better go start to dey happen
Know say gbege  go come and go 
We suppose to jump am o
We suppose to know say we must to rise up again 
Gbege must come and go 
We suppose to jump am o
We suppose to know say we will rise up again o

Watch Video

About Rise Up

Album : Rise Up (Single)
Release Year : 2021
Copyright : (c) 2021
Added By : Regee
Published : Jul 22 , 2021

More 2BABA Lyrics

2BABA
Oyi
2BABA
2BABA
2BABA

Comments ( 0 )

No Comment yet



About AfrikaLyrics

Afrika Lyrics is the most diverse collection of African song lyrics and translations. Afrika Lyrics provides music lyrics from over 30 African countries and lyrics translations from over 10 African Languages into English and French

Follow Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl