BURNA BOY 20 10 20 cover image

20 10 20 Lyrics

20 10 20 Lyrics by BURNA BOY


Shey you never hear
About the things wey happen there 
Abi your eye never clear 
Mankind so wicked

Lets talk about my government
Open your mind and your ears 
Wetin happen shey na jazz o
Make my people suffer suffer
All their nyanshes don dey open 
Everything don scatter scatter

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so WATER OOO WATER runaway my eyes
Nothing you go talk wey go justify

The case of their murder
The chief of staff
The commander and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo IJOBA
All your atrocity
All of your corner corner
Make all the DEADBODY disturb you for your dream

The money wey you thief yapa for your azza 
You don turn our graduates to common beggars 
All the book them go no matter
Cuz you no go get job if you no know godfather

The Chief of staff
The commander and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo IJOBA
All your atrocity
All of your corner corner
Make all the DEADBODY disturb you for your dream

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so WATER OOO WATER runaway my eyes 
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder

We give them many chances Dem FAIL my people
And When we cry for justice Them kill my people
Walahi ALL of YOU
Their lives are on you
We no go ever forget all the youths Wey die for TOLLGATE

Watch Video

About 20 10 20

Album : 20 10 20 (Single)
Release Year : 2020
Copyright : (c) 2020 Onaspaceship
Added By : Huntyr Kelx
Published : Oct 30 , 2020

More BURNA BOY Lyrics

BURNA BOY
BURNA BOY
BURNA BOY

Comments ( 0 )

No Comment yet



About AfrikaLyrics

Afrika Lyrics is the most diverse collection of African song lyrics and translations. Afrika Lyrics provides music lyrics from over 30 African countries and lyrics translations from over 10 African Languages into English and French

Follow Afrika Lyrics

© 2024, We Tell Africa Group Sarl